. The former Councillor of
Sapele Local Government Area of Delta State, (during the 2010
administration), Hon. John Onose, has been sent to Sapele prison, after he was convicted by the court for inflicting injury on a 6 years old girl.
Read below, as shared by sapele largest news page on facebook in pigin..
17/08/2016.
JOHN ONOSE THE RAPIST DONE ENTER PRISON.
Despite the many N2million plus, wey Dishonorable John Onose, pay and
spend from Sapele to Asaba and back to Sapele and to Court,so that he
nor go enter Jail for defiling of 6years old Girl with him joystick, the
Oga done finally enter Sapele Prison,as a lesson for others with same
mindsets.
Unu remember say we post am for here say this Oga,wey be Ex-Councillor
for Sapele Local Government Council back in 2010 and above. Call the
children wey dey play for him frontage,as some wey know am wella, run go
deir Houses,one small Girl of 6years wey nor know wetin this Oga fit
do,as dem just pack cum the area,cum use respect eyes take honour this
useless man call,not knowing say this man,wan make Love with her. After
the experience, this man come dey threaten the poor Girl mother,wey he
know say,he get money pass,say he go deal with am,and even went far to
arrest the woman and her daughter,due to say when the mother find
out,say her pikin under,nor dey normal,nai she ask the pikin,wey point
this very man.
Them say Cow wey nor get tail na God dey helep am drive the flies.
When the police officers,wey this man invite to cum arrest this woman
and her daughter,see the Girl condition,dem cum change their plans
as,dem arrest the man go but tori cum change,wen we find out say this
man buy him way out of Court the first time with Millions of money,so
that dem go withdraw the charges wey go indict am.
When we hear nai we put am for air,so that the world go see say
Injustice dey prevail over justice for Sapele High Court. After our
post,we receive so many encouragement not to back out of the case,as one
Mr Isreal Joe from Asaba,wey be Human Right activist and spokesman
Committee for the Defence of Human Right (CDHR) Delta State throw call
and assurance enter our studio say dem go buy this wahala take,to make
sure say nobody fit turn the case upside down for Court again.
My people na yesterday dem Sidon look this matter for Court and the
competent Magistrate really look into the matter well,as dem bring back
all the charges levied against this man and after the deliberations, dem
cum send this man to Sapele Main Prison to go rest him joystick wey nor
get control.
This morning we commend the efforts of everybody,most especially unu wey
support this case,through cash and kind,and to the Lawyers most
especially Barr Mike Egbune,the Female Lawyer Mrs Oj and Human Right
Activists from Asaba and most especially the Magistrate and unu wey
stand for this case back with prayers and support and our collective
thanks goes to God almighty wey dey use us dey fight for the oppressed
in our society.
No comments:
Post a Comment